Music

[Lyrics] Burna Boy – “20 : 10 : 20” Lyrics

Sponsored Links
20-10-20 lyrics, JotNaija: South Africa Music, Mp3 & Audio Portal

Download Audio Here

LYRICS

Shey you never hear
About the things wey happen there
Abi your eye never clear?
Mankind so wicked
Lets talk about my government
Open your mind and your ears
Wetin happen?
Shey na jazz o?
Make my people suffer suffer
All their nyanshes, don dey open,
Everything don scatter scatter

20th of October 2020
You carry army go kill many youth for Lekki
Na so WATER OOO WATER runaway my eyes
Nothing you go talk wey go justify the case of their murder

The Chief Of Staff, the Commander and the army wey carry order
Mr President, Mr Governor
Godfather, gbo gbo IJOBA

All your atrocity
All of your corner corner
Make all the DEADBODY disturb you for your dream

The money wey you thief yapa for your Aza (aza, aza)
You don turn our graduates to common beggars
All the book them go no matter
Cuz you no go get job if you no know godfather

The Chief Of Staff, the Commander and the army wey carry order
Mr President, Mr Governor
Godfather, gbo gbo IJOBA

All your atrocity
All of your corner corner
Make all the DEADBODY disturb you for your dream

20th of October 2020
You carry army go kill many youth for Lekki
Na so WATER OOO WATER runaway my eyes
Nothing you go talk wey go justify the case of their murder

We give them many chances, Dem FAIL my people
And When we cry for justice, Them kill my people
Walahi ALL of YOU
Their lives are on you
We no go ever forget all the youths
Wey die for TOLLGATE

The Chief Of Staff,
IJOBA, IJOBA

Aiiyii Aiiyi runaway my eyes
Aiiyii Aiiyi runaway my eyes

The Chief Of Staff…

(Protesters voices and military gunshots)

20th of October, 2020.

Leave a Reply

Back to top button